NAIJA LANGUEJ KONA (ISSUE 8)
MEK WOTA GET AI | Anzaku Emmanuel
Imagine as di night dey vex
                  E dey vex wit pipo dem
                  Wey dey carry mattrass on top
                  Their head, forget say dem get pikin.
Di night sabi vex sha
                  See as e karry wota
                  kom enta pipo dem room
                  Di wota full so tey
E kom dey troway
                  From pikin belle.
                  Chei, mi no dey laik am
                  Wen night decide vex laik this.
But wait, sey na di night
                  Cause am? Sey na di night
                  Block ol di drainage dem?
                  Sey, if di wota see road pass
E go pass jeje
                  But why e bi say na night
                  Wota no dey see road pass.
                  Why e bi say na when pikin dem
Don bigin dream dream
                  Wey dem go use for future,
                  Wey wota go miss road?
                  Dis awa contri sha.
Sey bi wi no fit pray
                  Mek wota get ai?
                  Since na awa pikin dem
                  E dey kil.
Mi won make wota get ai
                  Laik awa politicians dem.
                  Mek e eye dey shine well well,
                  Mi want make  e get eye,
Di way wey drunkard
                  Dey see road reach house.
                  Abeg, mek wota get ai
                  Mek wi contri beta.
 Anzaku Emmanuel na graduate of Economiks from Federal University Lafia, Nasarawa state. E dey live for Abuja-dem.
Anzaku Emmanuel na graduate of Economiks from Federal University Lafia, Nasarawa state. E dey live for Abuja-dem.
NA HOW HE HARD REACH | Animashaun Daniel
Wi try to form friendship
                  But dem say we too dey talk,
                  Na mek wi just lock up
                  Dem kom yarn say we nor sabi gbedu,
                  Wi kom try to dey d middle
                  Dem kom talk sey wi bi fake.
                  We kom look everywhere to see wetin we fit do
                  Na dere we kom find di solushan wey go last wewe.
Nor be say e elp us please pipo wewe o,
                  Wetin e do na to make pipo dey vex
                  Sometimes ehn, the solushan to any wahala
                  Na to remove the wahala komot.
Now ehn, we fit live beta life
                  Or wetin go bi the use
                  Wen you dey liv your life
                  For anoda pesin?
If to dey make pipo bodi sweet dem na exam
                  Pipo go dey fail like 98 times out of 100
                  The remainin 2 times go bi
                  Pipo wey don kpeme
                  Bikaus dem dey try please di world.
                  Dem win pipo heart o
                  But dem kpeme tru di process.
I don reach di konklushan say
                  Di onli pipo wey u suppose try satisfy
                  Na those wey get special kona for your heart
                  No bi general public o
                  Wey go dey force you to live the laif
                  Wey nor be your own.
 Animashaun Daniel na writer wey dey study for the University of Ibadan. He bin dey try to helep pipu through wetin hin dey write.
Animashaun Daniel na writer wey dey study for the University of Ibadan. He bin dey try to helep pipu through wetin hin dey write.
***
DIS NA FOR MAMA
Dis na for Mama
I know no deity laik her
I no fit compare her love with any other
Di love wey she get always dey appear
Even wen wi no merit
She get our backs like: ‘I garrit’
Na our prayer sey make she live long
She suffer, but she tag along
‘I no go leave my pikins comot’
She go talk when papa fight turn hot
Ha! That woman suffer
That’s why I no go ever forget her
Even with belle, she do business
Fry akara, sell okpa, with tiredness
Nine moons later, she born man
Baba God, no let mi forget dis woman
If I do, strike mi wit hot manna
Dis, na for Mama.
 Okori John Onah na writer wey get focus for family, gender, love and everyday struggle; a shortlistee for NHCP short story competition; and a blogger @ okorijohn.wprdpress.com.
Okori John Onah na writer wey get focus for family, gender, love and everyday struggle; a shortlistee for NHCP short story competition; and a blogger @ okorijohn.wprdpress.com.

