NAIJA LANGUEJ (ISSUE 6)
YANGA FO AFRIKA
By Alozor Michael Ikechukwu
A fit du yanga fo Afrika
Bot fo mai kona fo Afrika
We bi naija, yanga no bi fri
Bikos tolotolo go fes chop beleful
Bifo im yanga go stat.
A fo de du yanga fo Afrika
Bot yanga na yo poket
Na di jingili jingili we yo poket du
Bi di miuzik we yu go dans
If yu wan du yanga fo Afrika.
If yu wan si yanga fo Afrika,
Kom fo mai kona we bi Naija kona
Yu go si yanga insaid hongri
Yu go si as hongri de du yanga
Bikos chenj de ren fo evriwie.
Alozor Michael Ikechukwu na Navy staf wen im ej stil de fo di statin of 30 yez and kom from Umumbo fo Ayamelum Lokal Govament Eria, Anambra stet.
NA JONGUL by Eriata Oribhabor
Tell sombodi to tel sombi se, NEPA and PHCN na ten and ten pens. And wetin wi don si bifo, na im wi stil de si – NEPA no get lait. PHCN na daknes.
Tel sombodi to tel sombodi se, chenj na laisens to enta pawa. And wetin konsain old man wen neva fit setul im famili, konsain kontri wen stil de faind “road” fo aftanun.
Tel sombodi to tel sombodi se, na jenerato soraund mi wit ol kaind of nois and “smoke”. And di “sleep” wen a no fit “sleep” na im mek mai “head” de skata fo ol of dem wen don kom “rule” os bifo.
Tel sombodi, to tel sombodi, to tok wetin im ai de si bikos, na ol of os de fo insaid dis “boat”. APC and PDP don waka. Lai lai no go helep os kari awa kontri go op.
(Na won Emudianughe Prudence giv mi wetin Oyibo de kol, “inspiration” to rait dis jongul mata)
Eriata Oribhabor na puet wen de rait fo Naija languej and English Language. Im de du plenti tins abaut hau difren puem go enta evribodi bodi fo Naija.