Yeye smel by Eriata Oribhabor
stil de trowe fo di ‘rusty caps’ of Ibadan
na dost from puem of “Fist of Words”
wen skata from korekt “brains”…
plenti lain-dem wen de giv hop
to evribodi; revolushon
of tode – beta tumoro.
stil fo di old “street” of Ibadan
na plenti lain wen de mek pesin
du wok from insaid im bele
plenti lain wen fit kontrol evritin
fo Naija…rimuv wahala from
awa “streets” wen dem dekoret
wit yeye and shem.
stil plenti na dost of “Fists of Words”
“rhymes and rhythms” go de
Poshu yunivasiti
wen de faind hau to giv fud to gras
stil de luk fo magik of hau to wosh toilet.
If di noiz of smel from toilet-dem no stop,
wia bi di beta wen wi se wi bi?
stil de trowe from pipul, na plenti wori
of plenti kaind of tins fo awa land
wen dem put fo sainbod laik
majik wen go “free” ol of os
bot na chenj wen no fresh
na promis fo niuspepa
and telivision…
beta wen no get beta.
if dis revolushon de ron from di
botom of awa bele
and wi pomp am put fo awa “streets”
govment pipul go shek
awa eria of wahala go join bodi
to win wetin wi lost…awa “purse” to build
awa old “green” go “bright” egen
to finish yeye smel of “pain” and shem
and giv fud to ol awa pipul.
Na fo English Eriata Oribhabor dis puem wit STENCHES as di taitul bifo im kom chenj am to n Naija languej
Eriata Oribhabor na puet wen de rait fo Naija languej and English Language. Im de du penti tins abaut puem and hau puem-dem go enta evribodi bodi fo Naija.
MAI PAPA NA FAMA
Fud boku fo mai papa haus brekete
Pipul de chop trowe fo im fam, nyanfun nyanfun
Nebo de kol mi ‘blesin’ pikin
Bot onga no gri mi rest
No fud to wak
No wota to drink
‘Egbe -weja’, im pawa no get ‘pat tu’
Dem ‘boko’ mai sista dem enta bush
Mai ai komot wota laik ‘ blood’
Bot mai papa no si enitin du
Mai papa na fama
Bot a de liv laik bega pikin
Onga don niali kil mi
Na wen dis sofa-hed go end?
AWODIYA FUNKE
Funke na “Medical sociologist”, shi de fait fo pipul we get “Sickle Cell” diziz, shi de rait an shi laik foto wel-wel. Na shi de arenj di Eriata Oribhabor foto compitishon, dem don poblish ha puem dem fo difrent antoloji. Shi de wok on ha fest buk of puem dem.
PIJIN SWIT by Nwafor Eziafa Brenda
Pijin swit
Laik wain we fain
I de mek mai yan flou
Laik stret lain
Grama de dol mai stail
Na Pijin mek sens pas
A no de rimemba mistek
Bot to yan fo grama de mek mi ‘sweat’
Pijin shuo… pas jo
“Na dro sup a chop”
Hau a go tek tok am fo grama
Fo mi, grama don drop
Oyibo na grama
Pijin na to ondastand
Fo mi, grama na jara
Na pijin bi mai nomba wan
Pijin swit jare
I bi laik ‘Ogwo’ sup an ‘Stash’
I smut laik espres ‘road’
Infat, na ‘Ogbolo’ sup
A de skata maut tok
Mek mai maut fo no smel
A no bi ‘Oyibo’
So a no nid to de fom
A no bi ‘Obaiagbon’ (hu dash mi?)
A no bi Soyinka (a no rish)
Ivun sef, a no fit bi Achebe (fo wia?)
Mi, a bi Osas
Mek a tish yu smol:
“Talk” na “Yan”
“Craze” na “Kolo”
“Mummy” na “Male”
“Trouble” na “Gbege”
Oo “Kasala”
Shebi yu enjoi am?
A nou se yu enjoi am
Nwafor Eziafa Brenda
Brenda kom from Aniocha Saut Lokal Govament fo insaid Delta Stet, bot na Lagos shi de liv.
Wow. Brenda my sista. I de fil u fo hear. Sir eriata yor puem dem de giv me shigbaka. Awodi ma foto madam. U won kill pesin wit yor pidgin oo.una two much jareee. God go bles PIN dem ooo