Puem-Dem Fo Naija Languej (Issue 3)

Puem-Dem Fo Naija Languej (Issue 3)

YAWA DON GAS by Albert Seraphin

Briz don blou
Fawo yansh don opun
Ren don fol
Ded bodi leg don komot fo grev

Wetin yu du fo sikrit
Don ton sinima fo opun
Wetin yu de haid
Don ton vidio we evribodi de luk

Yawa don gas
Hand don fol
Gbege don bost
No levul egen

Enitin we yu du
Du am wel
Wetin yu do tode
Go kom ask yu tomoro

DSC_0067 gfAlbert Seraphin na Naija raita an puet we len Politiks fo Ambrus Ali Yunivasiti, Ekpoma, insaid Edo stet. Im join pipul we de promot Naija languej and naim rait ‘THE CLARION CALL; MY NYSC DIARY and Oda Puem Dem.’Im de liv fo Ajegunle-Ikorodu fo insaid Legos.

 

 

 

 

 

 

 

ELDA WE NO RESPEKT IMSEF by Alozor Michael Ikechukwu

 

Elda we no respekt imsef,
If smol pikin kari am fo hed,
Im klot no go kova di pikin aiz,
Bikos fama we no sabi wekop eli,
Go ton to lebora fo im nebo fam won de.

Elda we se im no de chop rat
Bot de yuz im tit shie am fo pikin dem
Wen dem go kol am smol pikin
Fo kansul of eldas mitin
Mek im no ves.

Elda we go folo pikin dem de ple fo nait
Wen dem go yuz im brokos ple ayo*
Mek im no ves,
Bikos na onli mumu de fait fo im rait
We na im sel bai imsef.

Elda we no respekt imsef
Smol pikin dem go yuz im biebie klin noz
Elda we no respekt imsef
Giv am chie fo bak
Mek nobodi evun hep am klin di chie!

*naija gem we na sids an hols dem de uz ple.
578112_10153637873634794_6205292961385596762_nAlozor Michael Ikechukwu na Navy staf wen im ej stil de fo di statin of 30yez and kom from Umumbo fo Ayamelum Lokal Govament Eria, Anambra stet.

One Reply to “Puem-Dem Fo Naija Languej (Issue 3)”

Leave a Reply