Puem-Dem Fo Naija Languej (Issue 3)
YAWA DON GAS by Albert Seraphin
Briz don blou
                  Fawo yansh don opun
                  Ren don fol
                  Ded bodi leg don komot fo grev
Wetin yu du fo sikrit
                  Don ton sinima fo opun
                  Wetin yu de haid
                  Don ton vidio we evribodi de luk
Yawa don gas
                  Hand don fol
                  Gbege don bost
                  No levul egen
Enitin we yu du
                  Du am wel
                  Wetin yu do tode
                  Go kom ask yu tomoro
 Albert Seraphin na Naija raita an puet we len Politiks fo Ambrus Ali Yunivasiti, Ekpoma, insaid Edo stet. Im join pipul we de promot Naija languej and naim rait ‘THE CLARION CALL; MY NYSC DIARY and Oda Puem Dem.’Im de liv fo Ajegunle-Ikorodu fo insaid Legos.

ELDA WE NO RESPEKT IMSEF by Alozor Michael Ikechukwu
Elda we no respekt imsef,
                  If smol pikin kari am fo hed,
                  Im klot no go kova di pikin aiz,
                  Bikos fama we no sabi wekop eli,
                  Go ton to lebora fo im nebo fam won de.
Elda we se im no de chop rat
                  Bot de yuz im tit shie am fo pikin dem
                  Wen dem go kol am smol pikin
                  Fo kansul of eldas mitin
                  Mek im no ves.
Elda we go folo pikin dem de ple fo nait
                  Wen dem go yuz im brokos ple ayo*
                  Mek im no ves,
                  Bikos na onli mumu de fait fo im rait
                  We na im sel bai imsef.
Elda we no respekt imsef
                  Smol pikin dem go yuz im biebie klin noz
                  Elda we no respekt imsef
                  Giv am chie fo bak
                  Mek nobodi evun hep am klin di chie!
*naija gem we na sids an hols dem de uz ple.
                   Alozor Michael Ikechukwu na Navy staf wen im ej stil de fo di statin of 30yez and kom from Umumbo fo Ayamelum Lokal Govament Eria, Anambra stet.
Alozor Michael Ikechukwu na Navy staf wen im ej stil de fo di statin of 30yez and kom from Umumbo fo Ayamelum Lokal Govament Eria, Anambra stet.

Hmmmmm… Great words here