PUEM FO NAIJA LANGUEJ (ISSUE 4)
GRA GRA NO DU AM by Albert Seraphin
Yu spred chest laik gosip
Kari mozul laik ‘war’ ship
Yu yuz ayon tek du shoda
De waka laik ongri gorila
Yu de jomp op an daun
Laik jangorova we si moni fo graund
Bros, koshon yo mora
Evritin no be gra gra
If yu laik disple laik Jet Li
Oo tia mozul laik Bruce Li
If yu no kari ki
Do no go opun fri
If yu laik mek yo vois kari ‘weight’
Mek i de tonda laik ayon plet
Hevun no go fol
And graund no go tol
FOLO FOLO by by Albert Seraphin
Mek yo yes bi yes
And yo no, no
No sel yo respet
On top plet of ‘fear’
Na yu bi yu
Yu no fit be anoda pesin
No bikos of shem
Chenj to hu yu no bi
No laf bikos odas de laf
No tok bikos evribodi de tok
Get yo oun fri maind
Odawaiz, yu go ton folo folo
Bikos yu wan folo fo lain
Yu folo oda pipul put pepe fo yo wund
Yu foget se dem tu get dia wund
Bot na dem nou as dem de blou am fo dia haus
Albert Seraphin na Naija raita an puet we len Politiks fo Ambrus Ali Yunivasiti, Ekpoma, insaid Edo stet. Im join pipul we de promot Naija languej and naim rait ‘THE CLARION CALL; MY NYSC DIARY and Oda Puem Dem.’Im de liv fo Ajegunle-Ikorodu fo insaid Legos.
GRA GRA NO DE PE by Alozor Michael Ikechukwu
‘Superman’ no bi bai gra gra
‘Bruce Lee’ for don flai
If laif na bai mozul
E fo neva dai.
Tek laif jeje
Mek yu no wund yosef
Yo oun na yo oun
Mek yu no de ‘rush’.
No bi wu de fes go fam
Sabi fam pas.
E no go haves pas
Di man we sabi fam pas.
Laif na bai gres an sabi
Kul daun mek yu len
Gra gra no de pe
Ova sabi-sabi de kil.
Alozor Michael Ikechukwu na Navy staf wen im ej stil de fo di statin of 30yez and kom from Umumbo fo Ayamelum Lokal Govament Eria, Anambra stet.