Puem Dem fo Naija

small-SLIDE 3
INTRODOKSHON Bai Albert Seraphin

AlbertOl of os sabi se Naija get plenti-plenti languej and na awa pidgin evribodi de tek yan foevriwia. Na im bi di only languej wen de bring ol of os toge
da bikos wons pesin sabi tok am, na yo broad oo sista bi dat. To tok fo pidgin na won tin, to rait wit am fit bi total konfushion. Dat na wai Naija languej kom to put Evritin fo propa-propa. Dia-fo, Naija languej na anoda mata; na anoda levul. If evribodi bigin to de rait fo Naija languej, awa raitin from pidgin go to anoda levul wen wi de kol Naija languej. Dis levul get wetin oyibo de kol standad wen mek languej pas pidgin. If yu wan si hau dis won de wok, mek yu join os for Puem-dem fo Naija languej.

ABAUT DI PUET

Albert Seraphin naNaija raita an puet we len Politiks fo Ambrus Ali Yunivasiti, Ekpoma, insaid Edo stet. Im join pipul we de promot Naija languej and naim rait ‘THE CLARION CALL; MY NYSC DIARY and Oda Puem Dem.’Im de liv fo Ajegunle-Ikorodu fo insaid Legos.

MAN MOS WAK
If yu si mi
De kari doti
Oo de du shumeka
Na bikos man mos chop
If a de kari loud fo maket
Oo de kol pasenja fo moto
No bi se mi sef laik am
Bot na mek man fo chop
If yu si mi
Pent haus fo morin
Pak shit fo nait
Mai broad, i beta pas mek a kari gon
Sista,
Se yu si mi fo pati
De shiafud and drink
Na mek man fo no hongri o
Dem se na maind
We no get wok
Na im devul
De ton to ofis
So  diafo
As govment no gri giv os wok
An man mos wak
Na mek mi put waka join waka
 

A GO TOK Bai Paul Abiola Oku-ola

Paul Abiola

ABAUT DI PUET

Paul Abiola Oku-olanaNaijaInginia we ton to raita. Som of impuemdem don de poblishfodifrenantoloji of puemdeminsaidNaija and foOyibo land. Im de live foIkorodu, foinsaid Legos.

[email protected]

 

 

A GO TOK

If a tok
Yu go se a don komegen
Yu won mek a kip kwayet
De luk as bad tin de apunabi?
Mbanu! a no go gri
Si as maipipul de sofa
Si as dem de krai
So mek a si, mek a no tokabi?
A no go gri
Pesin we tif pam kanel
Pesin we helep am kari am
An pesin we sidem de tif, we no tok
Na ol of dem bi tif
So if a si
An a no tok
Ivun if no bi mi tif
An yu no giv mi enitin
Bot bikos a no tok
Wi bi disem tin, tif
So a go tok